Tiwa Savage - Get It Together Lyrics






[Verse 1 - Paul Okoye:]
Proper planning na him dey save
No go do mistake
Dem go tell you say eya brother
Your days will be shining your future great
Brother no story oh, make you no regret, eya
If na to celebrate
You go plan am well
If na your planning day
Na so you go run away
So come make you gum body
With your baby boo
Seat down and discuss am well
Like you suppose to do

[Chorus:]
Cause the people wey sabi na dem wey dey plan well oh
Na dem wey dey plan well oh
The people wey sabi na dem wey dey plan well oh
Na dem wey dey plan well oh
For you wey no sabi oya come make we yarn well oh
Oya come make we yarn well

[Bridge:]
Like this, like that
Like this, like that
Oya get it together
Plan well oh, oh oh oh

[Verse 2 - Tiwa Savage:]
This thing wey you dey talk oh
E dey sweet my body
Dey totori my belle oh, oh oh oh eh
Na woman wey sabi
Na hin go plan well oh
And she go find the one wey go gel for her body
If na our wedding day
We go plan am well
If na our planning day
Na so we go run away
So make we join body, my baby boo
Make we discus am well oh
Like we suppose to do

[Chorus:]
Cause the people wey sabi na dem wey dey plan well oh
Na dem wey dey plan well oh
The people wey sabi na dem wey dey plan well oh
Na dem wey dey plan well oh
For you wey no sabi oya come make we yarn well oh
Oya come make we yarn well

[Bridge:]
Like this, like that
Like this, like that
Oya get it together
Plan well oh, oh oh oh

[Verse 3 - Paul Okoye:]
Who no know go know
Who no know go know
Wetin be the lesson
Planning na the blessing
E go help you dey manage money
Dey manage money
E go help you to manage your time and attention

[Both:]
Get it together you need to know
We need to talk am oh
Get it together make we dey go
Eh lelele
If na to make money
We go plan am well
If na our planning day
Na so we go run away
So make we join body my baby boo
Make we discus am well oh
Like we suppose to do

[Chorus:]
Cause the people wey sabi na dem wey dey plan well oh
Na dem wey dey plan well oh
The people wey sabi na dem wey dey plan well oh
Na dem wey dey plan well oh
For you wey no sabi oya come make we yarn well oh
Oya come make we yarn well

[Bridge:]
Like this, like that
Like this, like that
Oya get it together
Plan well oh, oh oh oh





Other Lyrics by Artist

Rand Lyrics

Last Posts

Tiwa Savage Get It Together Comments